There Are Two Ways

Ebenezer Obey

THERE ARE TWO WAYS

Chorus:
There are two ways /2ce My friend
There are two ways /2ce My friend

The one wey hin gate gbangba gbangba
The one wey hin gate smaller smaller
Which one you dey/3ce my friend
Which one you dey/3ce my friend

Stanza 1
The one wey hin gate gbangba gbangba
The one wey hin gate widey widey
Na hin lead to destruction many people dem dey waka waka
Waka waka waka waka waka o me I no follow follow o /2ce

Call: Abi you go waka waka
Resp: Me I no go waka waka o/2ce
Call: Abi you go follow follow
Resp: Me I no go follow follow /2ce

Stanza 2
The one wey hin gate smaller smaller
The one wey hin gate narrow narrow
Na hin lead to life o na few people dem dey waka waka
Waka waka waka waka waka waka o
Na hin I go follow follow o

Call: Abi you no go waka waka
Resp: Na hin I go waka waka o/2x
Call: Abi you no go follow follow
Resp: Na hin I go follow follow o/2x

Chorus:
There are two ways /2ce My friend
There are two ways /2ce My friend

The one wey hin gate gbangba gbangba
The one wey hin gate smaller smaller
Which one you dey/3ce my friend
Which one you dey/3ce my friend

Lyrics Submitted by Gbenga John Edun

Lyrics provided by https://damnlyrics.com/