VERSE1
My friend been dey sick,
E nor well oh
So I carry am go see doctor,
We go see Doctor
Doctor say na typhoid fever
Dey do am oh,
E prescribe drugs for us,
We go pharmacy, we buy am,
My friend swallow am.
Small time my friend belle
Start to dey pain am oh,
Before I know my friend
E don die e ye!
CHORUS
Which kind world we dey,
Wey man is so unkind
To man kind, so unkind
To man kind.
Shey na this world we dey,
Wey man is so unkind
To man kind, so unkind
To man kind.
VERSE2
Na my friend birthday,
So we say make we jubilate
Make we do party, make we
Celebrate.
We invite people, assorted drinks, different food,
People just dey dance
Dey jolly dey go, everybody
Happy, dey thank God e ye!
Small time people belle
Start to dey pain them eh
Before I know 300 people
Don dey for hospital e ye!
CHORUS
Which kind world we dey,
Wey man is so unkind
To man kind, so unkind
To man kind.
Shey na this world we dey,
Wey man is so unkind
To man kind, so unkind
To man kind.
VERSE3
I want you to know that
This song is about you
Wey dey make, wey dey sell
Sub standard product,
Fake drugs, silent killers,
Children murderers,
Grace diggers, innocent
People snipper, naija the riper, serial killer, cause of natural, disaster, death sellers, you think you unknown soldier, mass murderer, soul robber, dream shatterer, life snatcher,
Heartless brother or sister inconsiderate baggar, you kill another just to make a naira, oshe bobi dila! shege Dan iska! ejusi emanro! idiara, ah! Akpan yo! I danfu we!
CHORUS & OUTRO
Which kind world we dey,
Wey man is so unkind
To man kind, so unkind
To man kind.
Shey na this world we dey,
Wey man is so unkind
To man kind, so unkind
To man kind.
Lyrics Submitted by Jerry Dese