damnlyrics.com

Mr. President

Food e no dey

Brother eh water no dey

And our country no good o

Everyday for thief

One day for owner e

Poor man wey thief maggi

Omo, dem go show im face

for crime fighter Rich man wey thief money

Omo, we no dey see their face

for crime fighter

Tell me something now rudeboy

Rich man go dey halla prayer Poor man go dey shout Rich man go dey halla prayer Poor man go dey shout Make una lead us well

No let this nation to fall inside well

Mr. President If you be governor If you be senator If you be police Oya lead us well If you be senator If you be police Fuel e no dey

Brother eh transportation no dey

And our road e no good o

What about the NEPA people o

we no get light

Everybody just dey halla

fuel no dey, na how we wan survive

Many youth ready for work

but as work no dey

na how dey wan survive

We be giant of Africa

but to get visa enter Ghana

na WAEC Policeman go see white

e go tell you say

I say that thing na red

Tell me something my people

Make una lead us well,

no let this nation to fall inside well

REPEAT Alhaji wey pull Khaki

say the name of him party

People Destroying People

Na the name of the party

election for my country

na paddy paddy

wayo wayo

arrange no ni

People wey vote them in

still dey live in pain

This na disgrace

I am so ashamed

We don collect shop permit

Collect trading permit

trading permit

You still dey burn shop

You wan tell me say

you no know when them pay

Why you dey make us

dey live in pain

Make una lead us well

no let this nation to fall inside well

REPEAT Omo nothing dey par

Anything wey par na witch

Na im make we dey say

Omo no lele

Tanke (echo)

REPEAT 1

REPEAT REPEAT 2

Baba God help this country

REPEAT (till fade)

Song Discussions is protected by U.S. Patent 9401941. Other patents pending.

Enjoy the lyrics !!!